Monday, September 14, 2015

GBAGAUN, AFTER LONG HOLIDAY, SCHOOLS RESUME TODAY FOR OYO STATE


Shebi nothing wey get beginning wey no go end. Na him make am say the loooong holiday wey primary and secondary school pipu get for Oyo State don end and dem don resume today. So parents make dem dey package dem school fees for those wey dey private and those wey dey government school nko, make dem too package dem developmental levy according to waiting we gomina yarn. Education na still free but dat one no talk say make dem no pay at all all. After all, at all at all na winch and na him bad pass

No comments: