Monday, September 14, 2015

FINALLY FINALLY BUHARI LIST FOR MINISTERS DON DEY READY...FALANA, OYINLOLA, UTOMI DEY INSIDE


Some Aproko wey dey inside DSS do do ofofo yarn the public name of pipu wey dey inside the list wey President Buhari send give dem make dem shine light on top. According to dem, dem don chuke nose for this pipu dommot to know if yeye dey smell for dem dommot and dem don do am finish.

The pipu wey dey inside the list na Oga Femi Falana, the before before Oga Gomina for Osun State, Olagunsoye Oyinlola that we guy wey sabi book pass library, Pat Utomi plus including some pipu wey no too popular for politics. But I never see my name sha, I too sure say na second batch my name go dey.

No comments: