Monday, September 7, 2015

BAUCHI STATE SAY DEM DON SEE DEM PLANE WEY LOST FOR MORROCCO


Allahu Akbar....na wa o, Bauchi State say dem don see dem plane wey lost for where dem hide am for Morrocco o. Na dem Governor, Mohammed Abubakar yarn am on yesterday nite wen he dey hail him pipu for TV on top him 100 days wey him enter office.


Dem say na one committee wey dem set up for the state, wey one Air Commodore Ahmed Baba Tijanni (Rtd) lead na dem recover am. And very soon dem go collect am back officially for Abubakar Tafawa Balewa International Airport for Bauchi.

No comments: