Sunday, September 6, 2015

NA WINSH ABI NA CRAZE, 17 YEAR OLD BOY BEAT HIM GRANDMA ENTER COMA


Dis one no fit be clear eye o, tori yarn us say one guy wey drop commot from secondary school don take vexnation flog him grandma enter coma o on top argument for 20k wey dey miss.



The bad mata shele for abraka Delta State, on wednesday wen d grandma notice say the 20k wey she keep join firewood for her grand pikin thanksgivin don dey miss. Na so the mama start to dey swear for persin wey thief her money and na dat time the gonfabi boy enter wey he don high. And na when the mama hayaj am the guy vex finish wey he take rush the old mama. Beat am so tey she enter coma.

Police for Delta confirm the mata say dem still dey shine light on top the mata and wen dem do am finish dem go carry the badt guy go court.

No comments: