CHAI… DEM SAY 65 YEARS OLD COMMUNITY
LEADER DON DO JIBITI 419 O
Dem
show face of one 65-year-old community
leader, Wasiu Mayegun, for Igbosere Magistrate’s Court for Lagos yesterday on
top say he do N7.5 million jibiti. Tori say Mayegun, dey stay for Mayegun village, Eti-Osa
area for Lagos, and the bad things wey he do na conspiracy, jibiti, thiefery
plus including doing gbege for the area.
The Oga Police wey dey
in charge say the Chief do the bad things between April 5, 2013 and November
2014 for him dommot, Mayegun town for Eti-Osa Local Government Area for Lagos
State. Dem say he arrange with some other bad guys wey dem never fit catch to
collect N7.5 million from one Otunba Semiu Bakinson, say em wan sell one plot
of land for Mayegun give am, and all of dem know say na job dem dey job the
man.
Odugbo even say the take
strong head enter one plot of land for Mayegun town, and he scatter the fence
wey dem price for like N500k wey be say na one Mr. Alex Eyitene get am The
Magistrate, Mrs L. M. Balogun, sha give am bail for N500k wen him Lawyer beg
the court.
No comments:
Post a Comment