MY HAND NO DEY FOR THE
RUSSIAN CARGO PLANE WEY DEM SEE FOR KANO O, ALI MODU SHERIF DEY EXPLAIN.
Former Oga governor for Borno State, Senator Ali
Modu Sheriff, don cry out again o, say dem APC and him former political godson, Kashim Shettima, dey try
spoil him name join him life ni o, cos na dem even dey link am again with the
plane wey dey carry weapon wey dem see for kano.
Sheriff for inside one statement wey he make
available to journalists for Maiduguri, on Monday, shout come out say na lie o,
say dem just dey try spoil him name ni o, cos so far say him dey PDP, dem APC
sabi say nothing for dem for Borno, that na why dem dey tacke am, dey lie for
him head anyhow.
No comments:
Post a Comment