Tuesday, December 9, 2014


CHAI…SEE AS DEM FALL AKALA AND OBANIKORO HAND FOR OYO AND LAGOS STATE.
No be small mata yesterday o, when PDP do dem primary election for plenty States for Naija The result still dey shock some pipu o cos dem no believe am say na so life be.

Especially for Oyo state where former Senate Leader, Teslim Folarin win the ticket to take represent PDP for the election wey go shele next year, many pipu bin dey think say na former Oga Governor Akala go win am, but the thing be dem like action film wen dem hear say na Folarin win am. Na so e still be for Lagos where Jimi Agbaje fall the hand of former Senator, who still be former Oga minister of State for Defence, Musiliu Obanikoro to take win PDP ticket to represent dem for next years Gubernatorial election, where him go dey contest against Ambode wey win APC own.

No comments: