Wednesday, November 19, 2014

POPULAR YORUBA RADIO PRESENTER, OPEYEMI FAJEMILEHIN DON KPAIN O!




One popular persin wey dey yarn Yoruba take do programme for radio, Opeyemi fajemilehin wey still be former Oga General Manager for Ara FM don kpain o. Tori yarn us say the man wey bin dey get diabetes kpain on Tuesday, November 18th for him house wey dey Ilesha.


Dem born am sometimes in the 50’s for Igede-Ekiti and na for there he go primary school before him come go secondary school for Ikire wey dey Osun State.

No comments: