On top say she wan chuke hand and body for politics dem say
make una no too shock o say we own kate Henshaw wey wan run for position next
year don carry bowl dey do bambiallah o, as she don dey try raise money from
friends, fans and well wishers o so she go get cash to take do campaign.
Tori yarn us say many pipu come dey shock o, say how persin
like Kate Henshaw go dey yarn us say she
no fit pay for her campaign by herself on top all the endorsements wey she get,
afterall she don endorse glo, Onga, Samsung plus Naija Got talents wey make
evry body believe say over fat go dey worry her bank account. But sha o, she
just open one bank account and she dey yarn us say make we drop money for the
account o, make she take do campaign and dem say pipu wey dey generous don dey
drop better enter the account. But sha o when Nigerianfilms halla her to
confirm the matter, she say na true o but no be she open dem say na her goons
open am for her ambition.
No comments:
Post a Comment