Na wa for we Eagles o, as per say South Africa come do us
strong thing for we own backyard, ne dem even first score 2 goals before our
Gonfabi players come struggle equalize. And dat draw no fit carry us reach
nations Cup next year wey go happen for Equatorial Guinean.
No be small matter o, na small e remain make dem flog us as
dem promise o, even for the new Akwa Ibom International Stadium wey dey Uyo. Dem
come even give one of dem red card sef around 80th minute but upon
do do, we boys still no fit win. Dem sha don push us commot from the nations
Cup.
No comments:
Post a Comment