3 police women wey dey on duty jejely for Edo state don
receive the beating and disgrace of dem life by pipu wey dey stay for
Ikpoba-Okha Local Government for Edo State on Wednesday the 19th of
November.t beat dem o, Dem no just beat dem o, dem naked them join.
Tori wey the nation newspaper write na him yarn say one
Landlady, Mrs Okebuse na him halla Police say make dem come arrest one of her
tenants wey she don give quit notice say make she pack commot from her house,
but when Police show face the tenant wey dem no mention her name say she gats
to baff before she follow dem but the police no wan gree. Na so the woman take
cause gbege o and all the gonfabi wey dey stay for the area join am take deal
with the police women, dem gather hand beat dem come even naked dem join. Tori
say dem dey hospital now dey collect treatment , the Oga Police Commissioner
for the State, Folusho Adebanjo say dem go soon make dem face court for wetin
dem do as dem don arrest all the pipu wey get hand for the matter.
No comments:
Post a Comment