No be better time for the oyinbo pepper guy wey dey act film
for Ghana, Majid Michel as per say e no too tey wey him mama die, but apart
from that tori say some badt guys don dey take him name dey 419 him fans o, as
dem dey bill pipu dey collect money say dem wan take am arrange burial for the
guy mama, but sha o finally police hand don touch the bad guy wey dey do the
bad thing.
Unfortunately sha the badt guy na Naija pikin o, him name na
Kevin Ogodogu and dem say he don 419 one babe wey dey USA. IK say him go one
parry recently for USA na for there him meet one babe IKAY wey come dey famz
am, dey yarn am about how dem dey yarn on top social media and even yarn am
about the cash wey she don dey send am. The babe even yarn am say she don ready
to send the 5000 dollars wey he ask for to take arrange him mama burial, Mahjid
say no be only she o, dem don dupe another woman for Canada like 30,000
dollars. Na so he take inform police o and dem set trap wait for the Gonfabi. To
God be the glory he don fall yakata enter the trap.
No comments:
Post a Comment