Tori wey dey
run round dey yarn say the Federal Airport Authority for Naija no gree allow
the plane wey dey carry our bros, Oga Buhari make he land for Benue o. vanguard
say na him and hin goons bin dey travel from Bayelsa State to Benue State wen
dey fall dem hand so.
Dem say wetim
make Bros dey waka about naija no to toast dem APC pipu o, before dem
conference wey go soon happen for where dem go pick who gho be dem party
candidate for Presido. Pipu for him team dey para gan on top the mata o, say
what if fuel no dey inside the plane, wetin for happen. Because as dem no gree
allow dem land, dem gats to travel straight to Abuja, make e for no lost.
Dem APC Oga
for Benue say the level no pure at all o, cos all of dem and dem supporters bin
don gather dey wait for Bros before dem yarn dem the super story say dem no fit
land.

No comments:
Post a Comment