No be small
gbege o, wen House Committee members take vexnation scatter meeting wey dem do
with Oga Patapata of Police for Naija on top the kasala wey burst for the
National Assembly Complex on Thursday, the 201th of November.
According to
Sahara reporters, the IGP dey try explain wetin make him boys go hayaj dem for
the house last week, wen he say na better gist dem get say some badt boys wan
go do gbege for the place. Say na so dem see one Alhaji Aminu Tambuwal wey
carry some thugs for bag dey go hayaj policemen for where dem dey do dem lawful
duty.
Na so dem
vex pause am, say make he re address Tambuwal with respect as per Speaker
concern, but Suleiman Abba, the Oga Police no gree o, and na so dem take end
the meeting o, say if him no fit shoe respect give Tambuwal dem no fit follow
am yarn.
No comments:
Post a Comment