Wednesday, November 19, 2014

NA MILITARY PLANE FLY ON TOP SYNAGOGUE BUILDING TRUE TRUE O, POLICE YARN CORONER





One police investigator, SP Olusola Agoi say the light wey dem don shine on top the matter so far don show dem say true true na one military plane fly on top Synagogue Guest House wey fall on the 12th day of September, 2014.
 
According to wetin the Oga Police yarn, he say the plane na Nigerian Airforce own and dem say na circuit training mission the thing bin dey do wen the bad thing shele, he say even we Airforce don confirm am, but sha o some experts dey yarn say the plane no fit fall the building cos where he for dey fly no ft woundjure the building. He say the thing wey really happen be say the building no get permission.

2 comments:

Mistainer R said...

we don hear oooo

Mister Rain said...

we don hear ooooo