Na on
Wednesday dem approve am o, say make we carry 9.2 billion naira go buy stove
wey dem go take dey cook give our women under wetin dem dey call National Clean
Stove Scheme. Na one South African eco-entrepreneur na him create the designer
stove wey dem warn buy.
Tori say na
the supervising minister for Information na him talk am come out yesterday say
the Federal Executive Council don approve the mata for the meeting wey dem do
that yesterday. In fact dem say the wonder stoves go land in 12 weeks time. But
sha o na for Naija dem go couple the stove together o, so dem go take that one
create job for pipu wey dey find one.
No comments:
Post a Comment