Tuesday, November 11, 2014

CALL BRO JONA IDIOT OR DRUNKARD MAKE YOU SMELL PEPPER-OKUPE DEY PARA





Den say from now anybody wey take yeye name like idiot, drunkard, oponu, opelawawa or any other bad name describe we Presido again go smell pepper o, na so we presidency dey para o. Say the way wey pipu take dey spoil these days dey shock person o and that na why the Senior Special Assistant to the President on top Public Affairs, Dr. Doyin Okupe, say him office go carry am like contract to correct this bad thing.


Okupe say anybody wey him papa and mama no train for house, dem go dey help train dem now. When he dey yarn on top twitter say although him na grandpa the way pipu dey talk to we presido no make brain. How you go talk say you be critic go come dey take that one dey mess we presido. He say na one thing to criticize and anoda thing to abuse. Any body wey call presido idiot or drunkard and so on no
longer deserve any respect.

No comments: