Friday, June 17, 2016

WHO DEY TALK SAY MKO ABIOLA PINSHURE SUPPOSE DEY ON TOP 50 NAIRA?

One civil society group, June 12 Coalition of Democratic Formations, J12CODEF, don dey yan say make Federal Government gree say make den chuk pinshure of late Chief M.K.O Abiola, peson wey every every reason nahin win the June 12, 1993 presidential election, for the 50 Naira abi any other money wey dem go do for future . The group yan dis one yesterday, for one breifing inside  Lagos, plus say 23 years after the Presidential election, the central Government no even reason say make den do something wey go make him name dey forever . The group chairmo, Mr. Alfred Ilenre, yan say "make Federal Government even reason am say make den make sure say den find one day take do holiday for Chief M.K.O. Abiola.

No comments: