Monday, June 20, 2016

AFTA NBMA DJ GAVPOP DON PUT IBADAN FOR NAIJA ENTERTAINNENT MAP AGAIN WITH HIN NEA NOMINATION

Popoola Gafar wey everybody sabi as DJ GAVPOP na one kain bad DJ wey take Ibadan do hin kabaa and the bros dey rep Ibadan City wella. He join one of the few pipu wey dey clear pipu doubt say person fit dey Ibadan dey make brain for entertainment. Na for time wey no too tey he win the best in house DJ for a radio station for Nigerian Broadcasters Merit Awards cos the bros dey scratch well for Splash Fm. Naso we see am again as dem sama public the list of pipu wey dem nominate for dis year Nigerian Entertainment Award, say DJ Gavpop don still represent as dem nominate am again for Best DJ category... Pipu wey he go dey follow drag the award na DJ TBB, DJ Kelvin, DJ Enimoney, DJ Humility plus DJ Vinnie. So we for TPN say congratulobia brodaly, nothing does you and we sure say you go make us proud everly.

No comments: