Sunday, June 12, 2016

NAIJA ARMY DON RETIRE SENIOR ARMY OFFICERS WEY DO MAGO MAGO

Many senior officers of the Nigerian Army for yesterday nahin den retire dem  from service, according to one gist wey the  military spokesman, Colonel Sani Kukasheka Usman drop.  Colonel Usman yan say all the officers dem na the ones wey be Major Generals, Brigadier Generals, Colonels, Lieutenant Colonels plus  Major." The gist yan say na ontop the mago mago wey den do for office nahin make the army retire dem. But sha den no gree mention the names of the ogas dem.

No comments: