Sunday, June 12, 2016

LWKMD... WETIN NAIJA WAN TAKE PIPU PROPERTY WEY DEM SEIZE DO GO MAKE YOU LAFF

Mrs. Adeosun yan dis wan yesterday for Abuja when she dey gist  journalists after the Steering Committee of the Efficiency Unit meeting. We Minister of Finance, Kemi Adeosun, tok say the Federal Government don dey reason sayake den move some ministries plus department to building wey den colet from pipu wey tif we government money. We government yan say since last one year den don colet billions of naira for cash plus properties from corrupt pipu. The Nigerian Institution of Estate Surveyors plus Valuers don dey yan say make we government use all the things wey den colet say make den use am wella. Mrs. Adeosun con yan say den reason dis wan sake of say make the buildings dem no waste.

No comments: