Climate change nahin den say be one ogbonge wahala wey dey affect Akwa Ibom State as the state dey face different different kind of environmental wahala sake of say the geographical location plus other natural and human induced factors. Gov Emmanuel Udom of Akwa-Ibom State according to the state Commissioner for Environment plus Mineral Resources, Iniobong Ene Essien, yan say, the coastal lus riverine communities for the state nahin don dey affected dis nko nahin don make many many pipu pio pio pio comot ontop excessive sea level rise plus many many flooding. Wen E dey gist for the World Media Chat ontop the First Akwa Ibom State Climate Change plus Clean Energy Mega Summit/Expo 2016 for weekend, the Commissioner wey Mr. Samuel Bassey of the Governor's Office for Lagos represent am, con yan say the state government through Ministry of Environment plus Mineral Resources don dey tackle the mata.
No comments:
Post a Comment