Na State prosecutor, Mr Babatunde Oguntemowo, yarn court say Mr Babatope Adamolekun, yarn one Lagos state High Court wey dey siddon for Ikeja say on May 12, 2014 around Dat kain 8a.m, when he dey go work for Bello Bus Stop, Iju, Lagos, him see one 10-year-old girl wey dey beg one woman for money. He come ask am why she no go school, na so she start super story of how her mama don kpain l, so na her mama rival she dey follow stay and she need cash to go back. She say her papa don dey chop her ogbono for like one and half years and na small remain make she kpain from the one wey her papa do am the night before, COS HE go pass 3 times for her small body. Justice Kudirat Jose for siddon hear the full tori on Thursday, June 9, how Gbade Gemini wey be 40 years old don dey do hin own daughter strong thing for 18 months. The witness say he come ask the girl when her yeye Papa dey, she say the Papa na danfo driver and him bus no far from where dem dey, but the Papa no dey there he don go find petrol. Adamolekun yarn the court say na 4 pipu help am carry the Papa inside keke Marwa go police station. Justice Jose come push the mata go forward go Thursday , October 6, but say make dem go keep the yeye Papa for kirikiri.
No comments:
Post a Comment