One businessman for Lagos, Kehinde Akintoye, don write petition go give efcc on top one N5.6m yeye cheque wey one before before Commissioner of Police for Akure, Ondo State, Joseph Rugbere carry give am. For the petition, wey dem date March 23, 2016, and send give EFCC through him lawyer, Daniel Omakor, Akintoye say one Baba still follow the Oga police do collabo take 419 am. Akintola na the Managing Director for Kennimus Oil and Gas Limited, and he say na through Bada him supply 33,000 litres of diesel wey dey go like N5.6m give the Oga Commissioner before for Akure. He say the useless GTB cheque wey get the name of Rugbere Walter Joseph, get date March 26, 2013, na him dem carry give him company when dem deliver the petrol on March 23 for one filling station wey dey Akure. Akintoye explain say he complain give the middleman, Bada, when the bank yarn am say the person wey get the account no give dem power make dem make dem pay the money. He come go report the mata give the police.
No comments:
Post a Comment