Wednesday, June 15, 2016

GHEN GHEN... FAKE AIR FORCE OFFICER FLOG TRAFFIC POLICE WOMAN FOR LAGOS

34-year-old gonfabi , Lucky Onofua, na hin God don catch for Egbeda, Lagos State after he go form say he be Squadron Leader for Nigerian Air Force, come go flog one policewoman, wey dey control traffic. Tori yarn us say Onofua flog the female sergeant, wey dem Neva Sabi her name sake of say she stop him Jeep for Egbeda on Monday, na so the yeye fake Oga air force carry vexnation come down from him car come flog the policewoman. Tori say as the kasala dey burst, the sergeant na gree leave the cloth of the fake officer. One person wey dey there say Olorun jeep jam the policewoman small, na so she fall no gree stand up. Na some pipu wey dey pass go save the sergeant, come help am halla her padis for Shasha Police Division. When the policemen get to dat place, Onofua, wey come from Irrua-Central Local Government Area of Edo State, dem say make he identify himself, but he sha dey do strong head say him na air force officer. Na so dem carry am go police station where dem call dem Oga for Nigerian Air Force wey dey Ikeja, make dem come talk if dem sabi the gonfabi. Na so 2 Wing Commanders of the Nigerian Air Force go the station, na for there dem fall him hand say dem no Sabi Onafua. Police say dem go soon the guy face for court.

No comments: