Chaii... See money O, Naija stock market don fall by N1.732tn under one year wey Muhammadu Buhari take be presido for Naija O. Dem data for Nigerian Stock Exchange data show say the NSE market capitalisation for May 28, 2015 na N11.658tn, and the one for May 27, 2016 na N9.926tn. Market capitalisation na hin be the total market value for the shares outstanding for company wey dey trade for public. E no end for there O, NSE All-Share Index even fall go 28,902.25 basis points from 34,310.37 basis points wey e be before. PIPU wey put money for equity side of we country capital market lose more dan N1.053tn for first quarter of 2016. Tori yarn is say for first 3 months the level fall by 10.79 per cent. When dem open market January 4 dis year, NSE market capitalisation na N9.757tn, and All-Share Index na 28,370.32 basis points. But by March 31, the market capitalisation plus All-Share Index don fall go N8.704tn and 25,306.22 basis points each.
Tuesday, May 31, 2016
TOOR... NAIJA THROWAY N1.732TN UNDER BUHARI FIRST YEAR FOR GOVERNMENT
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment