Tuesday, May 31, 2016

#OLAYINKAMUSTGO : UI VC SAY DEM GO SOON OVERCOME ALL DIS GBEGE WEY DEM DEY FACE

As different level of kasala dey burst for UI head,  wey the students don vex climb on top social media DEY PARA say make government commot dem VC, sake of say he no wan make dem talk for wetin dem no like, wey dem even start hashtag #olayinkamustgo. The Vice Chancellor, Prof. Abel Idowu Olayinka don yan the staff members plus students even other pipu wey get mouth for the school mata for one press conference wey he do today for him office say all the yawa wey dem dey face nahin go soon pio pio pio, E con dey yan say all na time plus support, patience, and understanding. E yan dis one for one press conference for hin office, Prof. Olayinka tok say all the kasala na because of the economic situation wey we Naija dey face E con tok say hin administration dey work wella say dem want make the students return to dem classrooms ontime plus say dem wan look into the gbege of salaries of workers. According to wetin E yan, "Senate of the university go meet very soon sake of say dem wan find solution to the situation plus say dem wan reason the resumption date, plus say dem go dey gist the parents as tin dey go.

No comments: