Tuesday, May 31, 2016

NO CARRY FAYEMI ENTA WHY YOU NO FIT PAY YOUR WORKERS: APC PARA FOR FAYOSE

The All Progressives Congress (APC) for Ekiti State don dey yan Governor Ayodele Fayose say make hin no even try carry former Governor Kayode Fayemi enter why hin no fit to pay workers' dem salaries. Dem yan dis one tru dem  Publicity Secretary, Taiwo Olatunbosun, Dem con dey yan say na wikcedness if some pipu plus the governor begin blame Fayemi say E don already carry Ekiti state enta gbese before Fayose enta. Dem con dey praise Ekiti workers for dem  endurance as Fayose no gree pay dem the momey wey dem wok for. Fayose for last week nahin don blame Fayemi say E don go borow loan wey Ekiti no go fit pay finish until 2036. He con dey yan say money wey the federal government dey comot every month nahin mo make am dey easy to pay salaries.

No comments: