Monday, April 25, 2016

OYO STATE GOVERNOR ABIOLA AJIMOBI DON SAMA RED CARD GIVE BEGGARS FOR IBADAN

OMOBOLA - Oyo State Governor don say make all beggars clear for road, na yesterday he talk dis wen the Secretary to the State Government (SSG) Alhaji Ishmael Alli represent him at the second General Assembly of Muslim Umaah of South West, Nigeria wey dey Ibadan. He talk say some pipu wey dey beg dey use am do evil work, say Islam dey against begging and the government too don dey against am. He con continue say make the media, law enforcement agencies and religious pipu join hand together make dem help the government on top dis matter.

No comments: