I no fit laff alone O. Naija politicians go just siddon for older corner dey yarn anyhow about wetin dem no sabi. Dem go dey talk like say na dem Sabi pass. Na so El-Rufai do before he become Governor for Kaduna State, wey he come turn Governor finish dey yarn say he no Sabi say things din spoil reach like dat for the State. Na so dem take fall the hand of we Oga Minister for Power, Work plus Housing wey do well when he bin Governor for Lagos State. Na some pipu help am go compile him yarnings from way back, first he say in 2014 say only way Naija go fit get power na to chase PDP commot for power, wey we don do now. In March 2015, he still say dem go sama Naija power in 6 months pere. But yesterday, after dem don do 10 months almost one year for power, dem say we power for Naija for some moments fall to 0 Megawatt on the 30th of March, na so Oga Fasho come out yesterday come say make he no lie, dem no get enuff power to distribute ni. Lobatan. Na Oga Ben Murray Bruce dey open APC yan*h like dat for social media. Abeg make you Sabi how you dey yarn o.
Friday, April 1, 2016
OWUYE... SEE HOW RAJI FASHOLA MOUTH WAN KILL AM NOW
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment