Friday, April 22, 2016

MAKE UNA NO KILL TOYIN AIMAKHU O ....MERCY AIGBE DEY BEG

MISS SIMPLICITY - Mercy Aigbe send love give Toyin Aimakhu wey dey pass through marriage palavar through her instagram page oo. For d post she call Toyin her Edo sista nd she tok sey she o dey ready to dey always support nd love Toyin o. Mercy tok sey Toyin dey free o to com meet her for any tin o nd she dey ready to give her advice dat is if Toyin go gree listen oo.  Last last Mercy com tok sey abeg o make pipu wey dey tok tok abt Toyin leave her alone o base on sey na everybody dey do mistake wey dem dey learn from o. Hmmmm na beta tin u tok o ma'am Mercy, one tin na to give advice nd anoda tin na for d person wey u dey advice to accept d gud advice wey u give ham..May God help us o

No comments: