MISS SIMPLICITY - David Gest wey be entertainer for UK naim we hear sey he don kpai nd na for Four Seasons hotel wey dey Canary Whart tower hamlets, East London naim dem take meet him body. Imad Handi wey be David friend nd bodyguard before naim tok sey David na natural star nd na confirm celebrity wey him nd many
of fans go miss o. Wen dem ask d Metropolitan Police hw d tin take happen..dem tok sey na around 10:17am yesterday naim the hotel management call dem o sey dem meet David body for him hotel room nd dem no knw wetin kill ham o. The police tok sey dem go do post-mortem o make dem for fit knw wetin kill d man. Before him die, David wey be 62yrs bin don plan sey him go tour UK for July wit him latest show wey he call " David Gest Is Not Dead But Alive With Soul..." Hmmmm see plan. Na wa o, our prayer for TPN be sey make God give the family d strength wey dem go take bear dis lost ooo.
No comments:
Post a Comment