Music producer, Cobhams Asuquo wey no dey see with him 2 korokoro eyes don show us say him na complete Musician as he change am for us for inside him new single wey he call Boosit and he come finish the track as he feature Falz the Bad Guy. Cobhams turn himself to Ibadan boy just to show us say he Sabi wetin he dey do and the song na to talk about the pain wey dey go on for the country. He say ‘Don’t tell me boosit…I’m a human being, you can’t deceive me!’. Trust Falz with all him yeye grammar, he finish the song with him rap style wey dey very on point who deftly. The song no too heavy, COS you need hear wetin dem dey talk clearly and walahitalahi I dey love the song. If you wan download am, ask UNCLE Google. We no dey download for TPN.
No comments:
Post a Comment