Wednesday, April 13, 2016

I NO FIT FOLLOW MY HUSBAND USE ONE ACCOUNT - MIDE MARTINS .





MISS SIMPLICITY - Afeez Abiodun nd Mide Martins don marry for 13 yrs now nd dem get two girl pikin wey dem love wella. Mide Martins na one actress wey get talent nd swag, pipu even dey tok ham sey she dey act like d way her mama ( Funmi Martins) dey act d time wey she dey alive. Mide love her husband wella bt she don come out for one interview sey o she no fit follow her husband 


 use acct o. She tok sey her husband knw hw much dem dey pay her nd she sef know hw much dem dey pay d husband as e be sey dem two dey work for d same industry o bt sha dem two no fit put money for one acct bcos moni get power well well o, e fit cause kasala between two pipu even tho dem love demselve like sey tomorrow no dey, she tok sey to avoid yeye fight naim make she nd her husband no dey put money for one account oo... Hmmm..... Wise decision....

No comments: