MISS SIMPLICITY - No be small tin o, dis tori dey totori my body on top sey d person wey d tori tok abt na one person wey I dey gbadun.. Afeez Owo wey tori bin tok sey he pack leave him wife nd pikins naim we hear sey he don come back o nd Mide Martins sey she dey hapi o, she thank nd appreciate her fans for their prayer nd concern o. She com still thank her husband for d love wey him
show o nd she tok sey d man no be just her husband o, she sey d man na her Guardian Angel. Last last she com tok sey she go love d man till d kingdom com ooo. Now dis is wat I call love, e dey make sense make husband nd wife dey know wen to forgive nd forget wetin dem do give each other...Ma'am Mide, we for TPN dey pray sey wicked pipu no go pour sand for una garri oooo
No comments:
Post a Comment