Thursday, April 21, 2016

(FOTO) WOW.... GOD SAVE LAWRENCE OLISA, OGA OF INSPIRATION FM FROM ACCIDENT DIS MORNING



Make God sha continue to dey protect person ni O, na dis morning, Lawrence Olisa,  wey be Oga patapata for Inspiration FM, Ibadan climb on top him Facebook page to hail Baba God O. Say God save am from accident for Lagos Ibadan express way. From wetin he write na him and one of him office pipu. Mrs. Temitope Akindoyin dey inside the car wey dem carry travel. The car spoil but we Thank God say


 nothing do dem. Make God dey protect dem and all of us O. Na recently the Oga polongo say him Mama don cross the Jordan and Mama old well O. So time never reach in sha Allah, in sha Jesus. We for TPN follow you thank God.


No comments: