Wednesday, April 13, 2016

(FOTO) OLAJUMOKE AND HER FAMILY DON FINALLY PACK ENTER HOUSE WEY SUJIMOTO SAMA DEM

Shebi na yesterday we yarn you say Sujimoto Construction Company don talk say na very soon dem go sama Olajumoke Orisaguna the beta 3 Bedroom flat wey dem promise am afta she blow. Buy na Dat same yesterday dem sama dem the promise and dem don pack enter the beta house. Sujimoto come share pinshure of dem Orisaguna family inside dem new dommot. Make God help person ni,  make person Waka well,  some pipu don dey Lagos for like 10years now wey still dey sleep inside container. 

No comments: