Tuesday, April 5, 2016

(FOTO) EEYAH.... SEE WETIN MAKE DIS NAIJA HERMAPHRODITE DEY FIND MONEY

One Nigerian pikin wey get male plus female John Thomas don shout come out O,  say he need help. The 29-year-old wey him name na Oluwaseun Samuel Fajilade, na from Ekiti State and the guy abi na babe na  hermaphrodite and he go like do operation wey go make am guy alone.  Dem born am on March 16, 1987, as guy. But between age 12 and 15, na him woman bobb* begin show for him chest. But Sha O, Fairlane say he no dey do women monthly business and he still see himself as man. Na one organization wey dem name na Divine Favour Foundation dey handle the case and dem don throway some pinshures give pipu wey dey doubt. Dem say the bros need money O,  to clear the things wey he no like for him body. Abeg anybody wey God touch him mind make he help dis guy. God go bless una.

No comments: