Tuesday, April 5, 2016

CHAIII... SEE HOW MANY PIPU GET TUBERCULOSIS FOR ANAMBRA STATE

Over 2000 pipu wey get Tuberculosis dey collect treatment for different Directly-Observed Therapy (DOT) centres for Anambra State, the state commissioner for Health, Dr. Joe Akabuike yarn am yesterday. Akabuike say na Naija the thing dey worry pass for Africa, and we be number 4 among the 22 countries wey get am pass cos every year na 338 pipu dey get am inside 100,000 pipu. The commissioner, wey yarn with news pipu for him office for Awka, say na Anambra,  FCT plus 13 other states get over 75 percent of TB palava for Naija.

No comments: