Wednesday, April 13, 2016

AWWW....HEALTH MINISTER SAY FEDERAL GOVERNMENT GO PAY FOR GIRL WEY NEED NEW KIDNEY

Heaven don smile for one 14 year old girl wey her name be Faith Andrew and dem don stop to dey treat am for kidney palava wey she get for some time now,  because her Mama wey be  widow no get money to pay for her treatment wey she dey collect every week abi the N7 million kidney transplant money. Minister of Health, Isaac Adewole, go see Faith for the Gwagwalada Teaching hospital yesterday wey be April 12th and he say the Federal government go from now dey pay all the money for the girl treatment. We pray make God heal the girl and make he bless Oga Minister for that beta thing.

No comments: