For all of una wey be Olamide fans, oya O.... Make una dey get ready O, especially if you still like football join. Wetin wan shele, ma sef Neva Sabi O... But just some few hours ago na him Olamide put am for him instagram say make we dey expect YBNL STREET SOCCER. He no talk pass like Dat O, except say he still call for Sponsorship lush enquiries but many of him fans don dey ginger already for the comment wey dem dey drop and many pipu don dey imagine the kain fit wey the thing go sama dem. I believe anything from Olamide to the street dey always make brain. So we sef no fit wait O. Make I go buy soccer boot.
No comments:
Post a Comment