Monday, March 7, 2016

NAWA O.... DEPUTY GOVERNOR FOR YOBE STATE DON STILL GET ACCIDENT

Shebi na just yesterday tori dey yarn us say Oga Minister,  JAMES OCHOLI get accident wey kpain him,  him wife and dem first pikin. Now another public officer wey be Deputy governor for Yobe state, Abubakar Ali, don still get accident for Daka-Tsalle town wey dey Kaduna-Kano expressway today March 7th. Tori yarn us say the SUV wey carry the deputy governor go carry full front jam another car Toyota Aventis,  wey dey come from the other side. But we Thank God sha say Oga Deputy no woundjure but the Toyota Avensis somersault and e spoil well well. The deputy governor and him convoy later continue dem journey to Kano sha.

No comments: