For inside one press statement wey Simeon Nwakaudu wey be Special Assistant to the Rivers State Governor on top Electronic Media release, Governor, Nyesom Ezenwo Wike don polongo say APC no fit win any election for dem State. He still yarn say the Minister of Transportation, Rotimi Amaechi just dey carry money support gbege sake of say he no wan make dem forget am for politics. Governor Wike say
ma plenty corruption evidence wey dey ground against Rotimi Amaechi, the Minister of Transportation, na him make am dey threaten dem Oga for APC try say he go Loud am give the full world, the plenty money wey he spend for dem party campaign if dem no make am minister. Dat one still join how Senate Caucus of the PDP, wey the Minority Leader, Senator Godswill Akpabio dey yarn say INEC, musto release the results of the March 19, 2016 elections re-do wey dem gather. Na for one kain solidarity visit wey PDP Senate Caucus do give am, he for dey yarn say the Minister of Transportation fail for him local government area plus Federal Constituency, Dat na why he wan die to make sure say he do magomago for the election result.
No comments:
Post a Comment