Wednesday, March 30, 2016

ABRACADABRA... KACHIKWU DON TURN MAGICIAN, SEE WHEN HE SAY FUEL GO DEY NOW




Minister of State for Petroleum, Dr. Ibe Kachikwu, show before Senate Committee for Petroleum Resources (Downstream) yesterday, Tuesday to yarn dem wetin dey drink fuel, wey him ministry dey do for Naija.  Kachikwu say he regret O come beg Naija pipu, who he say dey suffer the mata. He come promise say


 the gbege go off on or before April 7. But Sha O, Kachikwu clear dem say he no dey resign from hin position as Minister,  so pipu wey dey plan to do Aluta,  make dem no just waste dem money O cos nobody fit make am not serve him Papa land. He come still apologize for that him talk say he no be magician, he say no joke he bin dey O. 

No comments: