Chibok Community for Abuja on Tuesday don yarn say the pikin wey wan throw bomb wey dem catch for Cameroon no be from dem community o, as per gist wey Federal Government don sama dem. The Chairmo for the community, Tsambido Abana, yarn news pipu on Tuesday say na conventional school the girl bin dey go, say she no even fit speak English, and all those things make
dem believe say the girl na from Bama area for Borno State. When dem ask dem if dem don see the girl pinshure, Abana say dem no gree release am to am or dem community members, he say na only Aisha Oyebode wey dey work for Murtala Muhammed Foundation na him dem show say make she confirm am. But he say he no dey go meet dem to see the foto, bcos everything wey dem don hear dey show dem say the girl no be from Chibok.
No comments:
Post a Comment