Thursday, March 31, 2016

SEE WHY FAYOSE SAY MAKE WE BONE DAT LEVEL... NO CHIBOK GIRL DEY MISS






Ekiti State Governor, Ayodele Fayose, on Wednesday don polongo say Boko Haram no kidnap any girl for Government Girls Secondary School, Chibok, Borno State. Tori bin yarn us say over 200 students na him dem kidnap in 2014.  The governor say na politics den take the report do so pipu go tear for Goodluck Jonathan government as 2015  elections dey show dat time.  Fayose yarn when he dey 
open one kain 2-day workshop on top “Political Aspirants Capacity Enhancement” wey dem arrange by Women Arise for Change Initiative,  dem do am for women from Ekiti, Osun plus Ondo states. He say, today plenty pipu wey fight govt dey underground and him no think say any of the girls dey miss,  shey all na political higi-haga. Fayose make dem no try fool anybody O, dem sha don commot who dem wan commot from office. He say if na true say dem dey miss, make we find dem na, he no come stop there O, he still take the #BringBackOurGirls campaigners rob am, say many of dem na appointment dem dey find. He say why dem enter ghost mode,  wey dem come turn deaf and dumb since President Muhammadu Buhari enter power.





No comments: