The Lagos State Internal Revenue Service say dem go start to dey treat f**k up of pipu wey no dey gree pay tax from April 1, 2016. The LIRS for one statement by dem Executive Chairmo, Mr. Olufolarin Ogunsanwo, on Wednesday say dem go do like dat O cos many pipu for LASGIDI no dey gree pay dem tax and
the law say make persin pay am 90 days for New Year. So dem say any body abi organisation, wey no gree pay dem tax to LIRS by the date, don do bad under law and na criminal offence and punishment dey for that kain thing under tax laws.” Ogunsanwo say dem don ready to do everything the service to make sure say pipu pay dem tax from April 1, 2016, and nobody go fit dodge am.
No comments:
Post a Comment