Thursday, March 31, 2016

SEE WETIN CHIEF DO PREGNANT WOMAN FOR LASGIDI WEY MAKE POLICE CATCH AM



Police for Lagos don catch one  chief for Ijegun area, wey him name na Ajiroba, on top say he hayaj one woman wey get Belle, dey sell bread seller, Bukola Olasunkanmi, for Isheri-Oshun area for Lasgidi. Tori yarn us say Olasunkanmi, wey get 7-months-old belle, na him dem flog wella by the chief plus his thugs bcos she chuke mouth for gbege wey dey shele between pipu wey dey collect govt money and 


another person wey still dey sell bread for the Ijegun bus stop. Tori say afta dem woundjure Olasunkanmi, dem first rush am to one private hospital, before dem still carry her go Igando General Hospital. We hear say dem go report the mata for Isheri Oshun division and police don catch Ajiroba. Olasunkanmi say afta she go report the mata,  she don dey collect different call wey dey fear her,  say dem go kill am ni, na him make her come write petition go give Commissioner of Police, Fatai Owoseni plus the Assistant Inspector-General of Police for Zone 2, Onikan, Bala Hassan.  She still say general hospital don ask her to dey come back so the beating no go touch her belle. 






No comments: