Ekiti State Governor, Mr. Ayodele Fayose, don accuse we Federal Government say dem don send plenty policemen from Abuja, on Tuesday, make dem come catch 11 members of dem state House of Assembly. One statement by the Senior Special Assistant to the governor on top Public Communications plus New Media, Mr. Lere Olayinka, say some top government Oga na him dem
go catch join the honourables. The statement talk say na one Chief Superintendent of Police, Mohammed Abubakar, wey dey for the Force Criminal Investigation Department, Abuja na him lead the police pipu enter Ado Ekiti. The statement say as DSS don fail, dem don rearrange come back again to do dem strong things starting from Tuesday night and dem Sabi O, say everything wey dem dey do na to force the honourables make dem commot Fayose from office.
No comments:
Post a Comment