Omobola - One man wey dey House of Rep , Mr Joseph Edionwele talk say make Edo state Governor and Adams Oshiomole dey redi to commot from the State government house , as the governor election go soon shele for September 10th, 2016. He say Edo state don ready for change, if person see the way dem
dey prepare he go Sabi say dem eyes don see suffer plus wahala for him government hand. He yarn say Oshiomole no do anything, road no change, health self no change. He say as Oshiomole come na so he dey go cos he no do anything at all and he no get one thing wey he fit leave behind am, he say PDP don ready to take over in September. Iyalaya anybody... He no talk Dat one O, na we add am, make e for sweet.... Lol
No comments:
Post a Comment